Watch
Loading...

Sokari no trust Enyimba

  Note: This article is written in Pidgin Kingsley Sokari wey be Enyimba midfielder don think am well well kon tok say as hin...

 
Note: This article is written in Pidgin

Kingsley Sokari wey be Enyimba midfielder don think am well well kon tok say as hin dey see things, say hin side Enyimba no fit get betta chance to defend dia title for dis Super Six game wey still dey shele.
De Federation Cup winners bin suffa 0-2 defeat by Naija small pikin side, de Flying Eagus for match day 1 for de annual football match wey dey shele for Abuja National Stadium.
Sokari don tok say de nation's Caf Champions League campaigners no prepare well for dem to win back de title becos of de yawa dem get inside dia club.
"I no dey 100 percent sure say Enyimba fit defend de Super Six title becos dem no dey mentally, physically and psychologically prepared as dem don spend de power and time wey dem get for matta wey no concern football.
"Others dey ready and prepare well well to win more dan Enyimba, na miracle e go be to see Enyimba win de title wen e go finish", naso de midfielder yarn supersport.com.
Sokari kon carry confido yarn say hin side go bilala Glo Premier League opponents Warri Wolves for match day 2 fight for Monday for de Sper Six game wey dey shele.
" De two sides match each other, dem sabi diasef well well, so de game go sweet well well and e go also tough but Enyimba go win atb lass.
"Enyimba carry one kain football swagger wey dem fit use to dominate Warri Wolves, i gada confido say we go betta dis time more dan wetin we play with de Flying Eagus", naso de Super Eagus playmaker yarn.
Enyimba go face Benin Republic side Buffles du Borgou FC for home for de fess stage of de Caf Champions League competition.
Watch
sports 2732324319632213144

Post a Comment

Disclaimer:
*DoroVibe's Blog Owner does not have or manage any other site or blog outside DoroVibe's Blog.
*None of these comments are made by the Author.
*Therefore, Every Dorovibe's member is solely responsible for anything that he/she comments or uploads on Dorovibe's.

emo-but-icon

Home item

Popular Posts